ALL DIE NA DIE

"For this gbege wey ai dey so, Jesus nor fall my hand abeg".

Na so oga dey pray o.
Leave family plus pikin come mountain come fire prayer.

Who wan blame am?
When devil play am wayo with im destiny, no bodi remind am wia church dey.
When the winch for villa knack im pikin correct sickness, no bodi remind am say God get power pass.
When im oga for office begin use sack letter do christmas for him fellow colleagues, no bodi remind am say the heart of a chairman dey God hand.

My bros fire prayer down. 

Agbada gburu God, epp me.
Jehovah overdo, na your hand I dey.
Jehovah Effizy, make my life beautiful abeg.
Jehovah Rohi, fire them wey dey fire me.

As time pass, baba God pick im call.
As my guy don promise to serve God, God carry am go high levels.

Im yawa, God commot.
Im gbege, God troway.
Confirm blessing, God arrange.
Correct doors, God break in for am.
Higher ground, my guy begin climb. 

Oga wey dey read.

Shey road don block for u?
Abi e be like say yawa dey do conference for una family.
No shaking eh.

Jesus say make you begin come.
No dull yasef if you reach dia o.
Hol am tight for prayer like Jacob hol God.
Tell am say all die na die but Him must bless you. 

Because if you dull eh,
Your own don finish kpatakpata.
As d don devil go use your destiny take fan himself for hell.
Abeg do the needful make you run go meet Jesus sharp sharp.
#NaBashorun


Okonta